Matchday one of di 2025 Uefa Champions League football competition go start dis Tuesday wit six ogbonge matches, anoda six matches on Wednesday and also on Thursday.
Dis na di second edition of di new Champions League format wia di first round go dey in league format, no longer for groups like e dey be bifor.
Afta di first round, di top eight clubs for di league table go qualify automatically for di second round or round of 16, but di clubs wey finish from 9th to 24th go face each oda over two legs play-off wia di winner go also qualify for round of 16 and di loser go dey eliminated.
Teams wey finish from 25th down don comot from di competition. E no be like bifor wia clubs wey finish third from dia groups go move down to di Europa League.
Dis na wetin you need to know.
Discover more from The Legit News
Subscribe to get the latest posts sent to your email.






















